3. Chukwuemeka
Nna, wetin my guy Henry for Abia state do me, chai e no good oo. If to say I wan do am wetin he do me, people go think say I don give my life to devu.
Nna, this guy... me and this guy be best friends for Abia state, we dey very close since we be pikin but my guy mess up, e almost take everything wey I don work for many years from me.
I no too go school like that but my guy go Lagos for his university education. Instead say make I go school, I con start business as you know say we Igbo men, we be business people. Na we get business itself, so I start business when I finish my junior secondary school.
Na selling of spare part I start, I con graduate to sell cars on credit, business was moving slowly but e dey always get better every time.
I dey sell for Abia state na e I con get connection to come Lagos to expand. Nna, you would have seen money. Money was coming to me like say e love me, I con like am. I con be big boy.
By the time wey I relocate to Lagos, I don get many boys wey dey work for me, I don even open mechanic in Lagos, Abia and other three states for this Nigeria.
Things dey go well for me as the years dey go, I con spot my guy, Henry wey be my friend from Abia. I con happy say I don see my padi.
I know say I na Henry fault for this problem wey I find myself but na me cause am. If to say I wise up, if to say I no look am as person wey I know before, I no go see finish.
Nna, make people dey always careful of people wey Dem never see for long oo.
Na so I see Henry con dey happy. I con tell am everything, to where my shop dey. We con dey hang out, dey go party wey he invite me. He even tell me say I fit do big boy for one club like this, naso I follow am.
The thing enter my head because say people dey hail me say I dey spend money. It went on for like two three weeks and I don too trust Henry.
Ah! If to say I know, if to say I know all these time. Henry con turn me to mumu. Th-th-that stupid boi, e con use me do mumu. Now, na me dey pay for am now.
About a month after we don dey hang out, Henry come my shop one day, tell me say e need help... financial help from me.
I no get issue with helping people but I no know why the thing dey do me somehow when he asked. I throway the feeling because Henry be my guy and I wan help am.
Na so I give am two hundred taasand say e go pay in two weeks. Two weeks came and I get call say my friend was going unconscious by the road side, I con fear say make nothing happen to am. I con rush go the hospital, when he wake up, he con explain everything wey happen.
E tell me say robber do am that thing and took everything from him. E say na GOD save am else dey for kill am. I con pity am, forget the money wey e hold.
Henry talk say e no get anything so as per say I be good friend, I pay for everything. The hospital bill, gave him some money to hold body till he gets back on his feet and all other necessities.
After like a week or so, Henry con tell me say he don lose him job, say his boss just give one kind reason to fire him.
See all this time, I still dey get that bad feeling say he dey lie and or na trap but mumu me still dey believe am.
I think say na charm he take use talk to me. Chai, Chukwuemeka, see ya life.
In short, I give my guy place in one of my shop to dey supervise. Na from that time problem start to come.
Three weeks after he resume work, the shop wey he dey supervise for me burned. No trace of anything when we get to the site after the incident.
The cars oo, the spare parts, everything... no trace of it every being there, na just leftover burnt grass and ground na e dey there.
The thing shook me, while we dey investigate into what caused the fire, the second place wey I get for Lagos, robbers invade and took everything I have there.
I wan run mad, I still no come out of the shock when Henry come meet me say one insurance company go pay for all the damages caused to my business.
I no know wetin be that but he explained to me and assured me that doing it will let me not spend a dime on what I lost. That I will recover am but I need to sign one paper like this.
I no too sure about it because, I no understand this insurance something and how they know say I loose something?
Anyhow Sha, after much persuasion, I agree and signed to paper, I no know wetin dey on the paper, I no even know any lawyer Abi person wey close to me to read it.
Now, it's been almost a year and I still dey try get back all my properties.
After I sign those papers, Henry say I go get visitors soon and before I know it, everything wey I work for vanish, gbam. E con dey look like Nollywood movie.
I dey wake up everyday dey look for remote to change channel because the channel too real. I wan die, Henry duped me and took everything I have ever worked for then disappeared like spirit.
Henry Oluchukwu Gabriel GOD will punish you there. Henry make I jam you for road one time, your family no go recognize you.
See wetin you turn me too, how person wey I know to be good go turn to an evil person wey reduce me to nothing.
Na you take all my properties, burn my shop, send your cousins to rob my shop, still use the fact say I no go school and I dey depressed at that time to take my hard work. All those stupid lies you told so you can get closer to me. GOD will judge you Henry and I pray not to have someone like you in my life.
Na before I dey shout 'fear women' see better fear who you never see for long. Dey fit be the one wey go be your downfall.
I don learn my lesson, I just dey pray say GOD go hear my prayer and recover all my lost things to me because e don tire me.