Naija dey known for vibrant culture, rich heritage, and talented artisans. But many creatives dey face challenges on how Dem go fit to showcase and monetize their products and services. Luckily, creatives software developer for Naija don come up with e-commerce and digital marketplaces to help bridge dis gap. For dis article, we go dey explore top platforms wey artisans, crafter’s, artist, writers, content creators and entrepreneurs fit use to sell their digital and physical products, reach more customers, and grow their businesses. This platform fit help you sell digital products like ebooks, artwork, graphic design, music, illustration, fashion illustration, clipart and software, fit sell for these platform wey go help you earn passive income even when you dey enjoy sleep
1. Selar
Selar na popular e-commerce platform wey dey specifically for African businesses. Dem dey front line for FBBA (For Black by Black) businesses. The platform dey free to open with user-friendly interface and affordable fees for pro user, Selar allow artisans, and creators make dem create online store, showcase their digital products, and connect with customers nationwide. The platform dey easy to open in less than 10 minutes and you fit connect immediately to global audience or your fans by sharing your market link.
2. Qshop
Qshop na e-commerce platform wey enable artisans and small business owners to create online store to sell either physical or digital products to vast customer base. The store dey user friendly and very easy to set up. This one sef fit reach audience from Africa and the world. Just like Selar you no go pay any money to open your shop Na only just sikini charges Abi percentage dem go collect the moment you sell your market but dem no go charge you anything if you no sell any market.
3. Flutterwave Storefront
Flutterwave, wey be leading payment solutions provider also get Storefront feature wey go enable businesses to create online store and sell physical products directly to customers. Dem also get products payment links if Na digital products you wan sell. Dem get large marketplace wey plenty pipo fit see your market and choose wetin dem wan buy and dem also partner with courier service wey go help you carry your market go give your customers the moment dem make payment for wetin you dey sell anywhere dem dey for Naija. Flutterwave Na one of the strongest payment platform for Naija and e come dey easy to open and set up your store. Dem go help you dey push your market go up wey plenty pipo go see wetin you dey sell. Dem no go even charge you any money for opening store and na free you go take open your store with them.
4. Paystack Storefront
Paystack na another prominent payment gateway wey dey also offer Storefront solution wey allow artisans, startup businesses to create online store and sell products with ease. For paystack you fit sell both digital and physical products and services to your customers. If Na digital one your customers pay dem go send the digital download immediately to him email make Dem download. You fit sell courses, digital services, music, film, Software and artwork. Dem even get product payment links like flutterwave and e dey very easy to setup and start selling unlimited products to Africa and global audience. People dey there payment platform the PayPal of Africa.
In conclusion, dese platforms dey offer Nigerian artisans, creatives, content creators, digital artists and entrepreneurs conducive environment to showcase their tinz, products, and services, expand their customer base, and grow their businesses. By leveraging dese platforms, creatives fit tap into vast potential of e-commerce, increase their online visibility, and contribute to the growth of Naija’s digital economy. So, wetin you dey wait for? Sign up for dese platforms today and carry your physical and digital market walka go global stage!